Thursday, April 7, 2011

Joke of the Day

E get this particular restaurant wey i dey chop for Abuja, e get one oyinbo wey dey always com chop there too. Any time dis oyinbo chop finish he go shout "HEY", so i wonder wetin dey make am shout, i decide to chop wetin the oyinbo dey always chop so i go shout too. 

When i reach restaurant the next day I order wetin the man dey chop they tell me say na chicken and red wine, so i chop am, but I no shout, I collect xtra plate, but stil I no still shout. Na then I just vex ask for my bill,the waiter tell me say one plate of chicken na N35,000 & red wine na N25,000 then the extra plate na N20,000 na then i shout heyyyyyyyyyy! heyyyyyyyyyyyy!!!!!

No comments:

Post a Comment